Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,161,668 members, 7,847,734 topics. Date: Sunday, 02 June 2024 at 05:41 AM

Enyimba Don Win Federation Cup - Sports - Nairaland

Nairaland Forum / Entertainment / Sports / Enyimba Don Win Federation Cup (623 Views)

Pictures From The 2014 Nigeria Federation Cup Final Enyimba Fc 2 Vs Dolphin Fc 1 / Eyimba Vs Dolphins FC Federation Cup Final ( 2 - 1) On 23rd November 2014 / Enyimba Vs Warri Wolves Federation Cup Final 2013 Match Pictures: (2) (3) (4)

(1) (Reply)

Enyimba Don Win Federation Cup by viczing(m): 6:29pm On Nov 23, 2014
Enyimba don win de 2014 Federation cup wey happen for deTeslim Balogun Stadium on Sunday, afta dem bilala Dolphins 2-1 for de final.Na Dolphins take kukere take start de match for de fess half, as dem get plenty chance wey dem suppose take score, but dem troway all de opportunity wey demsee.De eye of Enyimba golkipa, Femi Thomas see fire for de fess half becos Dolphins strikas dem wan take shot kill am, but de guy strong kakaraka for back as hin parry all de shot kommot.As Enyimba kon see say Dolphins dey dribble dem well well for de match, naso de Aba boys kon turn de match to fite and naso de refiree take waya Enyimba strika, Emeka Nwanna de fess yello card for de match.Dolphins strika, Emem Eduok get anoda chance wey hin for take score wen de match enta 30 minute, but Enyimba golkipa parry de shot wey hin play kommot for corner.As de fess half wan finish, na hin Enyimba kon open dia eyes kon begin dey tap beta ball, but time no dey again for dem as de refiree blow de fess half wisu.Enyimba vex enta field for de secon half like say dia coachi, Kadiri Ikhana don para for dem, and bifor Dolphins sabee wetin dey happen, Mfon Udoh don waya de fess goal for Enyimba.De goal wey Udoh score na beta goal wey sweet de belle of all man wey dey inside stadium.Na Dolphins golkipa, Sunday Rotimi na hin kon cause de kasala wey Enyimba take score de second goal wen de match enta 72nd minute.Dolphins sabee strika, Emem Eduok kon waya one goal back for de Port Harcourtteam wen de match enta 79th minute, but de goal no fit helep hin team as Enyimba win de match 2-1.De koko now for dis match be say dis na de fess time wey Dolphins go lose for de Federation cup final, and de thing pain dia coachi, Stanley Eguma for body.Enyimba for dia own side carry de cup back to back becos na dem win am also lass year.

http://ng.supersport.mobi/football/nigeria-naija/news/141123/Enyimba_don_win_Federation_Cup
Re: Enyimba Don Win Federation Cup by Udpconcept(m): 6:59pm On Nov 23, 2014
Up the peoples elephant

(1) (Reply)

Messi To Chelsea?obviously Not Says Mou / Age Scam Rocks Nigeria U23 Football Camp / Check Out The Top 10 Scoring Defenders In Europe

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 14
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.