Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,163,363 members, 7,853,626 topics. Date: Friday, 07 June 2024 at 08:21 PM

Liverpool Mind Na Water As Chelsea Dey Come - Sports - Nairaland

Nairaland Forum / Entertainment / Sports / Liverpool Mind Na Water As Chelsea Dey Come (600 Views)

Liverpool Under Water As Safety-first Approach Is Sunk By Yellow Submarine / BREAKING: Jose Mourinho Sacked As Chelsea Manager / Jose Mourinho Sacked As Chelsea Manager (2) (3) (4)

(1) (Reply)

Liverpool Mind Na Water As Chelsea Dey Come by Basit002(m): 10:00pm On Nov 07, 2014
As Liverpool dey prepia to follow Chelsea play on Saturday, nobodi go tell dem say de 2-kondo wey Chelsea waya dem las season, spoil dia plan to win Premier League title for de fes time, since 1990.
Liverpool skippo, Steven Gerrard, bin fall yakata, helep Chelsea score dia fes goal, bifor dem score numba two for mortuary time. Jose Mourinho dey carri Chelsea go Liverpool now
, wit 12 point gap between two of dem, and na four point dem dey carri gap Southampton for second.
As Luis Suarez waka comot Liverpool, go join Barcelona, plus Daniel Sturridge come carri wound, na onli 13 goal dem don score for de 10 match wey dem don play dis season. Bicos Newcastle and Real Madrid waya dem for two strait match, gbege dey ontop dia coachi, Brendan Rodgers, head.
"We no dey try," na im Rodgers yarn amebo pipu on Thursday. "We dey try fin how we fit score plenti goal."
"De match go tuff for us, sake of say dem neva troway any match. Chelsea gada sabi-sabi, plus playas wey don dey dia since."
Many guymen bin yab Rodgers, afta hin carri one kin yamayama team play Real Madrid, for Champions League on Tuesday, sotay hin leave Gerrard and Raheem Sterling ontop bench, as Real waya dem 1-kondo.
"I carri boys wey I bin feel say go fit play Real Madrid. My playas over try sef," na im Rodgers tok.
But some forma Liverpool playas don tok say Rodgers yab, as hin no show say Liverpool don win Champions League five tines.
"Dat one no konsin me. Tok, tok no dey worry me," na im Rodgers tok.
"Na to jus face ya work. Anytin I do, na Liverpool dey my mind.
"Our plan na to stay de match reach 65 minit, come opun am as de tin wan finish. De playas make my mind sweet."
Get daily sport news in PIDGIN at http://pidginsport..com/

(1) (Reply)

Mikel Throws Party For Girlfriend Ahead Of Congo Clash / Enyeama And Uche Ike Did Not Report Late To Camp – Ben Alaiya / Football Facts You Didn't Know

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 9
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.