Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,155,892 members, 7,828,152 topics. Date: Wednesday, 15 May 2024 at 03:26 AM

Funniest Pidgin Proverbs Ever - Jokes Etc - Nairaland

Nairaland Forum / Entertainment / Jokes Etc / Funniest Pidgin Proverbs Ever (21377 Views)

Some Common Nigerian Pidgin Proverbs / Hilarious African Proverbs Ever Thought Of From Across The Continent / 40 Hilarious Pidgin Proverbs. (2) (3) (4)

(1) (Reply) (Go Down)

Funniest Pidgin Proverbs Ever by JustJosh20(m): 5:55pm On Sep 06, 2015
If u agree with these proverbs , Say "ii" if u dont agree.... shut up 1. Na for old age ashawo dey know the value of pikin. 2. Woman wey never see problem... Na im dey still hold breast run. 3. Woman wey dey find pikin no dey wear pant sleep. 4. Rat wey follow lizard enter rain, Na later é go hear am. 5. Na for afternoon dem dey find black goat. 6. Weather hot!! É No mean say fowl go lay boiled egg. 7. EYE WEY DEY CRY DEY SEE ROAD. 8. Pikin wey him mama back cross water, wey say him march fish, wetin him mama go march? 9. Small pikin wey dem carry for back no know say the journey far. 10. Person wey don faint before no be stranger to death. 11. Person wey chop belle full, no know wetin hungry man dey see. 12. No be as woman dey close eye enjoy sex she dey enjoy labour pains. 13. Yansh no get teeth but e dey cut shit. 14. Lizard wey fall from tall iroko tree, if nobody hail am!! é go hail himself 15. Toto water small, but é reach prick take baff. 16. IF GIRL TAKE HUSBAND DO BOYFRIEND, SHE GO TAKE BOYFRIEND DO HUSBAND. 17. Cockroach wey jam fowl, jam bad luck. 18. Na cricket tell him children say, No matter how ground strong, Them no go sleep outside. 19. Pikin wey say him mama no fine they use style call him papa blind man. 20. No be eye wey dem take chop eba dem take dey share meat. 21. Person wey use Elephant set trap, na him know wetin he wan Catch. 22. When Breeze Blow Fowl Yash Go Open. 23. STUDENT WEY READ NA HIM SERIOUS, BUT STUDENT WEY PASS NA HIM KNOW BOOK. 24. Dem no dey tell tortoise say race don start. 25. Dem no dey tell blind man say salt no dey for food. 26. Before you see monkey, monkey don see you. 27. Thief wey jump fence enter house where owner dey wait for am, no go jump again. 28. If pikin say he sabi die, him papa sef go tell am say him sabi bury. 29. Na wetin dey sweet for goat mouth, Na im dey kill am. 30. If e be like say everybody dey craze" na you dey craze. 31. Meat wey you dey forbid, no use your teeth cut am. 32. My thing and our thing no be the same oh. 33. Add Urz The I hav it

6 Likes 2 Shares

Re: Funniest Pidgin Proverbs Ever by frankay430(m): 5:59pm On Sep 06, 2015
lol
Re: Funniest Pidgin Proverbs Ever by Nobody: 6:13pm On Sep 06, 2015
Hehheheheehehehehehe grin cheesy grin cheesy


Hilarious
Re: Funniest Pidgin Proverbs Ever by yanabasee(m): 6:26pm On Sep 06, 2015
Buahahahahahahahahhaahahahhahahahaahaha grin
Re: Funniest Pidgin Proverbs Ever by kelvyn7: 6:27pm On Sep 06, 2015
I like pigin no be small cheesy

1 Like

Re: Funniest Pidgin Proverbs Ever by ossaii(m): 6:35pm On Sep 06, 2015
9ice one!


Who no know go know when jungle mature.

Shey na today nyash don dey back.


Fellow nairalanders help me with likes cry

3 Likes 1 Share

Re: Funniest Pidgin Proverbs Ever by babyfacenumb1(f): 6:36pm On Sep 06, 2015
Loooooooooooooooool!
Re: Funniest Pidgin Proverbs Ever by Electronzeez(m): 7:26pm On Sep 06, 2015
grin grin grin grin
Nice one

Pesin we de cry de see road.
Re: Funniest Pidgin Proverbs Ever by highbeetohbadt: 7:55pm On Sep 06, 2015
@op nyc 1,u carry me along, so ty i laff fall frm ur back, na d day wy mosquito go land 4 ur testicle na im u go no say violence no solve every matter

1 Like

Re: Funniest Pidgin Proverbs Ever by Vicintonsh(m): 10:33pm On Sep 06, 2015
grin grin
Re: Funniest Pidgin Proverbs Ever by DeHero1: 6:08pm On Sep 07, 2015
Na person wey no know him mother boyfriend dey call am bros.
Re: Funniest Pidgin Proverbs Ever by ajasa4link: 11:00pm On Sep 07, 2015
Pikin wey use agbada take start boiz, go talk wetin he go wear when e old.
E go better E go better, na im still make ibo man dey kano
Re: Funniest Pidgin Proverbs Ever by babasade(m): 2:16am On Sep 09, 2015
Pikin wey say him mama no go rest him too no go sleep Person where no get money no dey go find toto
Re: Funniest Pidgin Proverbs Ever by Rainalove: 2:03pm On Sep 09, 2015
Lol...If u do anyhow, u go see anyhow
Re: Funniest Pidgin Proverbs Ever by pinky21(f): 10:21pm On Sep 09, 2015
MINE:
No be today Nyansh dey back wen ee get centre parting.

Come chop don turn come fat.

Food no sweet but we see made in China for the plate.

Feel at home don turn come break video cd

Dem no dey tell blind man say war don start.

Na clap dem take dey enter dance.

Na smile dem take dey enter cry.

I GO DROP MORE LATER

2 Likes

Re: Funniest Pidgin Proverbs Ever by ossaii(m): 9:30pm On Sep 10, 2015
lalasticlala Pls do ur tin
Re: Funniest Pidgin Proverbs Ever by omophunky(m): 9:07am On Sep 12, 2015
.

(1) (Reply)

Nl Men, Please Pick Yer Fave Female Ladies (state Ur Reasons 2) / Nairalander/ Threads/ Posts That Made You Laugh Hard In 2015 / Don't Read These Jokes! (Else You Break Your Ribs!!!)

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 16
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.