Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,158,814 members, 7,837,930 topics. Date: Thursday, 23 May 2024 at 12:46 PM

Only In Naija - Jokes Etc - Nairaland

Nairaland Forum / Entertainment / Jokes Etc / Only In Naija (982 Views)

Things That Can Kill You In Naija / Bill Gates Surprised To See Microsoft Slippers In Naija / When Your Mother Buys You A Made-In-Naija Toy --- LOL (2) (3) (4)

(1) (Reply)

Only In Naija by Adeyinka1758(m): 7:34pm On Mar 30, 2016
*ONLY FOR NAIJA*
.
Na only for Nigeria you fit win Aeroplane by loading
N200 MTN Recharge Card.
Very soon Etisalat go say
recharge N200 and win a big ship. Then Airtel go com follow sey, recharge N100 and win
Benin Republic.
Glo, go just kuku ma say... Recharge N500 and win
Nigeria because their colour na Green.
.
Na only for Nigeria you go see fish inside "MEATPIE" .
Na only for Nigeria we dey count money after we
withdraw am from ATM because we no even trust ATM
machines.
.
Na only for Nigeria PHCN dey sey:- Win a brand new GENERATOR if you pay your light bill (wat a pity)
.
Na only for Naija people dey horn for traffic light make
e quick change from Red to Green.
.
Na only for Nigeria Pharmacy dey sell Coke, Recharge Card, Chin chin, Puff puff and beer.
Wetin you no see for Naija, you no go fit see am
anywhere in d world...
Trust me.
.
Na only 4 naija you go find a graduate of Mechanical Engineering dey do him NYSC 4
Police station.
.
Na only 4 naija you go see one person dey use Bold5,
X3, Ipad2 and Nokia N8 all at once.You be Bill Gates?
Abi na you invent internet? .
Na only 4 naija you go see a graduate of law dey work
as generator repairer.
.
Na only for Naija u go buy coke, dem go say make u
no forget to return d bottle. .
Na 4 only Naija,
you go see madman dey control traffic, people wey
their head correct dey obey...
.
Na 4 only Naija, you go see advert from native doctor on how to make quick money. Way he
himself no get kobo
.
Na only for Naija u go wish somebody 'happy
birthday', he go answer 'same to u'.
. Na only 4 Naija obituary poster dem go say "MAMA
HAS RELOCATED"
Lolz like I started,,, only for naija Tipnaija Enjoy *COPIED*

(1) (Reply)

Lagosians Can Relate With This (picture) / Lol.. Help Me Interpret This Girls Facebook Update / Something Shocking and hilarious Happened In Imo State (pic)

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 8
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.