Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,160,388 members, 7,843,149 topics. Date: Tuesday, 28 May 2024 at 07:19 PM

My Experience: Pidgin English Short Tori - Literature - Nairaland

Nairaland Forum / Entertainment / Literature / My Experience: Pidgin English Short Tori (1005 Views)

Sex Na Food (Pidgin Comedy Edition) Story Of A Rugged Guy By Youngzubi / TORI TORI (my Lagos Experience Story) / "Nwa Aba Na City" (a Pidgin Story) (2) (3) (4)

(1) (Reply)

My Experience: Pidgin English Short Tori by JohnieWalker(m): 3:29pm On Aug 24, 2016
Decided to write a pidgin story...

Kukuruku! Kukuruku!! Kukuruku!!!
Una dey hear d kin alarm for this our yard. Na Mama Reggie cock be that o, the cock don dey entice me since day 1 but d cock na old layer o and na so e wise because every time wen I go line corn for am reach inside my kitchen na so e go chop reach door cum smile, fly comot. I don dey suspect the fowl since because d fowl fit don dey gossip my mata give other fowl for the area o because anytime dem see me dem go just dey run anyhow.Wetin go make fowl dey discuss person mata for area. Make I yarn una small tori about who I be. Na me them dey call Broda tatashe or some dey call me broda atarododo na dem know but na when I go steal for Madam water melon kiosk dem give me d name o. I just baff finish dat night na say make I find way chop fruit but money no dey hand to chow na I stroll reach d corner of Madam Water melon side o thief small fruit o I no know say na day na my fowl wan lay cook egg o. As I enta d corner of the kiosk people full ground dey discuss na so I use style draw the fruit wet dey d tray o but since everywhere dark na so I throw am put for mouth dey chew I cum dey feel say d tin cum dey hot me for mouth o, na so my mind cum dey argue with my sense say e fit be Chinese garden egg or na Aba made garden egg na so i begin shout o....Fire o! Fire o!! Fire o!! D mumu boys wey dey drink near d kiosk just dey hala...burn all my enemies!burn all my enemies!!! Na wen dem start dey shout...send down d rain! Send down d rain!!! Na dere i understand wetin bible talk wen e say..."dey shall surely gather....." Na wen i cum dey hala i thief chinese garden egg o!! I thief i go confess o...dem ekenedilichukwu pipo don kill me o!!! Aba pipo wetin i do una o?.!! People just dey gather but for my side wetin i dey see na d uncompleted building for hell fire wen devil bin dey show me na dere i provoke as i dey argue say i dey come for hell fire country, chop ataradodo pepepper say I deserve 4 bedroom flat...Na dere I pass out o..

(1) (Reply)

Life Of HBK ((heart Break Kid))--season 1 / Romantic Doctors By Horlorlardaey / How I Was Able To Raise #250,000 To Start My Beauty Parlor...

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 56
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.