Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,160,458 members, 7,843,393 topics. Date: Wednesday, 29 May 2024 at 01:33 AM

Bet9ja !! Give Me My Birthright !! Give Me My 10% !! - Business - Nairaland

Nairaland Forum / Nairaland / General / Business / Bet9ja !! Give Me My Birthright !! Give Me My 10% !! (5209 Views)

Start Business With Advanced B2B Portal & Save Upto 10% Today / Let Us Find Properties In PH For You And You Pay 5% Commission Instead Of 10% / Freighting Of Cargoes Rises By 10%, Says NAHCO Chief (2) (3) (4)

(1) (2) (3) (Reply) (Go Down)

Bet9ja !! Give Me My Birthright !! Give Me My 10% !! by PrinceDoxx(m): 11:33pm On Apr 06, 2017
Man pickin enter online unto say make he fit make money as him other mates dem dey make money!!!


I don sabi about sport betting before Seun ever think say he go do nairaland.

Wayback in those days when I be dey FUTA in my predegree days since 2008... I remember say na my best friend Shumzy carry me enter football betting trips...that year , that year.....omo, e don they gan.

Back then, Real Madrid fit dey play Eyimba of Aba make bet365.com give Real Madrid 2.5 odds say dem go beat Eyimba. ( omo, no think say na joke I dey joke for here ooo)

I fit talk say na me and my padi first sabi about online sport betting for our everybody wey dey do predregree that year with us. Omo, but as everything be ehn, our two never even reach 19 years then and na chicken sense just dey for our head that time. Our two no for once take am serious at all...we no see am as an opportunity to transform our life to the level wey Olamide and Wizkid dey today today....

We no get sense !!!

At all, At all....

You self know!

Cos if to say we get sense ehn, I no go dey here as a graduate dey write for here like this today !!!

Re: Bet9ja !! Give Me My Birthright !! Give Me My 10% !! by PrinceDoxx(m): 12:02am On Apr 07, 2017
As time no dey wait for no man ehn, as we dey enter year 3 for uni, we begin dey see some kind people wey call their self L'DLLIC or so... Dem say na dem do naijapredict.com.

E no too tey we begin dey play naijapredict as we begin sabi as ee dey go...

That year, person be dey feel say naijapredict.com na part of the Federal Government direct project for poverty alleviation for the youth dem...


We no know say na one person wey get head like you and myself get am.

4 Likes

Re: Bet9ja !! Give Me My Birthright !! Give Me My 10% !! by PrinceDoxx(m): 12:14am On Apr 07, 2017
Like play, like play....the guyman wey get naijapredict don use all of our head take turn billionaire SHAAARP !!!

NO GAWK AM !!!


Omo....naso L'DDLIC abi wetin dem call himself or their selves don sharperly scrape gorinmapa for us!!!

1 Like

Re: Bet9ja !! Give Me My Birthright !! Give Me My 10% !! by PrinceDoxx(m): 12:24am On Apr 07, 2017
E no too tey ooo, some copy copy cats don join follow body...

Dem 1960bet dem....

Dem Merrybet dem...

Dem Bet9ja dem...


Even our smart loving brother Akin Alabi wey him work na to just dey sell eBook for we nairalanders of dah year....JOIN DeM. Baba stop to dey sell us educational ebooks... Hehehehe...Baba now don turn Politician.

2 Likes 1 Share

Re: Bet9ja !! Give Me My Birthright !! Give Me My 10% !! by PrinceDoxx(m): 12:41am On Apr 07, 2017
Make una no mind me...I sharperly go wake my babe up make we sharperly chop Eba wey my hommies turn...


No vex say I no call una....


But as una can see ehn, based on logistics, una still fit come join me.
Re: Bet9ja !! Give Me My Birthright !! Give Me My 10% !! by PrinceDoxx(m): 12:41am On Apr 07, 2017
As ee dey hot.

1 Like 1 Share

Re: Bet9ja !! Give Me My Birthright !! Give Me My 10% !! by PrinceDoxx(m): 12:43am On Apr 07, 2017
Make I dey go before bae go finish the EBA for me....


I no know say Hausa girls dey like EBA ooo until I meet this one!!! grin shocked
Re: Bet9ja !! Give Me My Birthright !! Give Me My 10% !! by PrinceDoxx(m): 12:55am On Apr 07, 2017
Na only God know wetin Victor Ikpeba go dey chop now...?


No wonder Olamide talk for one of his song say :

' O pay mi kin lowo, ki ma tabon bi Victor Ikpeba .'

1 Like 1 Share

Re: Bet9ja !! Give Me My Birthright !! Give Me My 10% !! by PrinceDoxx(m): 1:16am On Apr 07, 2017
Last Last ehn... if you base everybody on logistics; the primary goal na to get money... Bone say the logistics of the people wey poor pass the logistics of people wey be millionaire; na NAIRA everybody dey find for NAIRA-land...

Everybody just get different methods, ways, washing and settings wey everybody dey apply to get this NAIRA....

And na those wey apply the best washing and settings be the BILLionaires wey me and you dey see so...


Omo, if you believe in your own washing and settings ehn, just bone!!! Na steady massive cashout e go be for you....because you don WASH your LOGISTICS before you SET am.

Nobody go tell you, na play play you go use take become BILLionaire.














Abi no be person be Davido wey get frog voice but he get




30 BILLION for the account oooooooOooooOo














Dey there....siddon there you hear....sense still dey hard you bah

Okay...Continue....maybe na until when 'Mr based-on-logistics' commot BBN house enter naija with the 25 million wey he don win already..











































































Based on Logistics.








Na that time you go know say you supposed 'COMMIT TO' your hustle.







How many of una don COMMIT TO your BET9JA HUSTLE ?





HMMMM....


HOW MANY?

1 Like 1 Share

Re: Bet9ja !! Give Me My Birthright !! Give Me My 10% !! by omobacyprus(m): 8:18am On Apr 07, 2017
Ahhhh.. Aye leee.. Who did this to you
Re: Bet9ja !! Give Me My Birthright !! Give Me My 10% !! by topyhanky(m): 9:10am On Apr 07, 2017
Omo, bros....I dey feel this your tori gan oooo.....following you fender to bumper....

Make I no lie you, bet9ja don do me wicked thing, meself gats do my own back...

3 Likes

Re: Bet9ja !! Give Me My Birthright !! Give Me My 10% !! by PrinceDoxx(m): 10:33am On Apr 07, 2017
omobacyprus:
Ahhhh.. Aye leee.. Who did this to you

Omo....mesef no know ooo....I be wan ask you sef....
Re: Bet9ja !! Give Me My Birthright !! Give Me My 10% !! by PrinceDoxx(m): 11:01am On Apr 07, 2017
topyhanky:
Omo, bros....I dey feel this your tori gan oooo.....following you fender to bumper....

Make I no lie you, bet9ja don do me wicked thing, meself gats do my own back...

Wasere....meself ready carry you along so far you ride fender to bumper with me.....

Bet9ja don do almost everybody wicked thing....if not all the people!!!

Unto say people know say sport betting na one of the fastest way of cashing out in this our dispensation.... But a lot of people still never wan hear word!!!

Dem dey ALWAYS fail to establish certain facts...

They fail to know that e no get any business wey any guyman for this life go establish wey he go want make people come ruin!!!!

Every business owner or sole proprietor reasons a particular idea....and whether you know it or not ....this particular idea was predetermined to put food on his and his family's table.


Shey he go come dey look you to come ruin the business for am?


The bookies are smart.... They know the ultimate rules, which is :


'YOU CANNOT WIN THE HOUSE'


And If you cannot win the house, wetin manpickin suppose come do?


' IF YOU CAN NOT WIN THEM, THEN JOIN THEM' ....' pata pata ALL NA STILL WINNINGS'




So brother, the way to WIN the bookies is not by revenging or planning to avenge for your losses....

The ONLY WAY to WIN the bookies na to WIN WITH THEM.





The smart ones wey get better capital comes up his/her own bookies...na why you see say bet9ja and co don plenty for outside, and the smarter ones don pursue the mumu ones ( dem 1960bet and naijapredict dem) commot market by giving mouth watering incentives wey dem know say people no go lai lai chop... Because they know say ee no get any kind awoof wey Nigerians no dey like chop...

And Nigerians wey mumu na eem plenty pass....Dem don forget say:

'AWOOF DEY RUN BELLE.'





So brother, why plan revenge against this smart people?

Why you no kukuma join make you eat part of the NATIONAL CAKE ??

Why you no just run away from the AWOOF and eat your 10% birthright CONSISTENTLY from dem?


EHN??

WHY NOT?

2 Likes

Re: Bet9ja !! Give Me My Birthright !! Give Me My 10% !! by Aprilfirst: 3:12pm On Apr 07, 2017
Hmmmn.......make i pitch my tent here see where dis tori dey go...
Re: Bet9ja !! Give Me My Birthright !! Give Me My 10% !! by PrinceDoxx(m): 8:58am On Apr 09, 2017
Aprilfirst:
Hmmmn.......make i pitch my tent here see where dis tori dey go...

This one wey you don pitch a whole TENT for here so, e go make sense make I go quickly to the point....

Make I sharperly go straight to the point...

Make my matter no tire everybody here...
Re: Bet9ja !! Give Me My Birthright !! Give Me My 10% !! by PrinceDoxx(m): 9:11am On Apr 09, 2017
E no get how you fit beat or win the bookies on a daily basis.... Without having a working strategy,

LAI LAI !!!

The ONLY SURE way to CONSISTENTLY chop daily 10% from the bet9ja dem na to get strategy wey you dey use for them....

And to get Strategy wey dey control human beings wey dey play ball for obodoyinbo to ACTIVATE the betslip wey you don stake on no be beans...!!!


E don tey wey I don dey see different people dey WASTE their hard-earned money to dem Bet9ja dem unto say :

1) Dem greedy

2) Dem no get planning

3) Some get planning, but dem no dey follow am

4) Some people just dey bet anything wey they want make ee happen, instead make dem bet werrin suppose fit happen

( Even people wey dey bet werrin suppose happen never dey see their tickets chop wella)

1 Like 1 Share

Re: Bet9ja !! Give Me My Birthright !! Give Me My 10% !! by PrinceDoxx(m): 9:29am On Apr 09, 2017
I know say ee go get some people for here wey go like hear word and join me Using My PERSONALLY DEVELOPED STRATEGIES......

If you be person wey don lose your thousands or millions to dem Bet9ja dem....and the matter don tire you, you don quit to dey play sport betting, e be like say you no get choice than to join me to let me helep you to cash out your steady and daily birthright from them as ee dey hot!!!


Or


You be person wey still dey play bet9ja, but you never dey cash out steady....Just chill out, RELAX....


Based on Logistics, Prince Doxx has got you covered...


Una no get worries any more!!!

1 Like 1 Share

Re: Bet9ja !! Give Me My Birthright !! Give Me My 10% !! by PrinceDoxx(m): 9:37am On Apr 09, 2017
Based on Logistics, make ee no be like say I too dey talk....make I feed una eyes with the kind choppings wey me dey chop for Bet9ja....

Make you know say if you dey collect your birthright from bet9ja steady, na your CAUSE...

AND


If you NO dey collect your birthright steady from Bet9ja dem, na still your CAUSE...!!!
Re: Bet9ja !! Give Me My Birthright !! Give Me My 10% !! by PrinceDoxx(m): 9:43am On Apr 09, 2017
Too much of talk, dem say is bad....




No Gawk the kind money wey me dey collect as birthright from dem Bet9ja....

No be my fault oooo, na dem first go open office for my head ....




grin grin

2 Shares

Re: Bet9ja !! Give Me My Birthright !! Give Me My 10% !! by PrinceDoxx(m): 9:55am On Apr 09, 2017
Me, I sabi werrin don dey some people mind already.... So many mixed feelings go don dey my naija people's mind.... But I go always dey here to treat your case !!!


Some people be like, how much you don chop wey I just dey here dey fumble??!!!


Well, I no dey here for such people....


Me dey here to help those wey don ready pitch their tent with me....


I'm ready to help as many as possible the people wey ready helep themselves!!!


If you dey here dey follow this thread today,since the time wey I create am dey manage with my long tori.....


Consider Yourself Luckier than Lucky Dube cheesy wink

1 Like 2 Shares

Re: Bet9ja !! Give Me My Birthright !! Give Me My 10% !! by PrinceDoxx(m): 10:02am On Apr 09, 2017
No

Think


Say


E


Don


Finish...


Me

Still


Dey


Murder


them !!!!



ZERO

JOY,


HAPPY

PUNTING!!!

1 Like 1 Share

Re: Bet9ja !! Give Me My Birthright !! Give Me My 10% !! by topyhanky(m): 10:06am On Apr 09, 2017
PrinceDoxx:
I know say ee go get some people for here wey go like hear word and join me Using My PERSONALLY DEVELOPED STRATEGIES......

If you be person wey don lose your thousands or millions to dem Bet9ja dem....and the matter don tire you, you don quit to dey play sport betting, e be like say you no get choice than to join me to let me helep you to cash out your steady and daily birthright from them as ee dey hot!!!


Or


You be person wey still dey play bet9ja, but you never dey cash out steady....Just chill out, RELAX....


Based on Logistics, Prince Doxx has got you covered...


Una no get worries any more!!!


Hmmmmm.......
Me I no want get worries ooooo
I dey here tight waiting oooooo
Make we see whether nah true they dey talk or nah lie
Based on 2baba
Am waiting patiently for the birthright to come
Re: Bet9ja !! Give Me My Birthright !! Give Me My 10% !! by PrinceDoxx(m): 10:07am On Apr 09, 2017
E

No

Easy

To

Dey

Collect


Over


50k

From

Bet9ja


Everyday!!!!



grin grin




Still


Doubting?


lipsrsealed



Check

the

Dates

On


My


betslips

And

Do

The

Arithmetics

Yourself.

#Enjoy
Re: Bet9ja !! Give Me My Birthright !! Give Me My 10% !! by PrinceDoxx(m): 10:10am On Apr 09, 2017
topyhanky:

Hmmmmm.......
Me I no want get worries ooooo
I dey here tight waiting oooooo
Make we see whether nah true they dey talk or nah lie
Based on 2baba
Am waiting patiently for the birthright to come

Shey

2baba

Dey

Place

Bet

Ni



Make

I

Teach

Am

As

Ee

Dey

Go!!!
Re: Bet9ja !! Give Me My Birthright !! Give Me My 10% !! by bolanto24(m): 10:41am On Apr 09, 2017
Following
Re: Bet9ja !! Give Me My Birthright !! Give Me My 10% !! by afoltundeseun(m): 10:49am On Apr 09, 2017
cry cry

Commandant Se.un go soon yank this thread throway
Re: Bet9ja !! Give Me My Birthright !! Give Me My 10% !! by 10eola(m): 10:50am On Apr 09, 2017
Where's the strategy ? undecided
Re: Bet9ja !! Give Me My Birthright !! Give Me My 10% !! by Nobody: 11:09am On Apr 09, 2017
Hehehe. .. We full ground
Re: Bet9ja !! Give Me My Birthright !! Give Me My 10% !! by swagagolic01(m): 11:11am On Apr 09, 2017
Baba give us the strategy na
Re: Bet9ja !! Give Me My Birthright !! Give Me My 10% !! by kanzjude: 11:25am On Apr 09, 2017
Baba drop me strategy na
Re: Bet9ja !! Give Me My Birthright !! Give Me My 10% !! by fergieboy: 11:45am On Apr 09, 2017
PrinceDoxx:
No

Think


Say


E


Don


Finish...


Me

Still


Dey


Murder


them !!!!



ZERO

JOY,


HAPPY

PUNTING!!!

Sharpaly create a WhatsApp group and drop the link before se un yank off the thread
Re: Bet9ja !! Give Me My Birthright !! Give Me My 10% !! by WikeJnr(m): 12:29pm On Apr 09, 2017
Fvck your bloody A*ss dog! Just wasted my precious time reading your watery stories to no avail.

1 Like

(1) (2) (3) (Reply)

Does Paytm Work In Nigeria? / NSE Commends Nigerian Breweries As New Managing Director Visits Lagos Floor / Natural Gas Production Rise By 8% – NNPC

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 42
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.