Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / NewStats: 3,162,451 members, 7,850,572 topics. Date: Wednesday, 05 June 2024 at 04:10 AM |
Nairaland Forum / Nairaland / General / Culture / Can Somebody Please Teach Me Pidgin? (29630 Views)
HAUSALAND: Teach Me Hausa / Please, Teach Me Efik/ibibio (calabar/akwa-ibom) Language. / Teach Me Naija Slang Please (2) (3) (4)
(1) (2) (3) ... (15) (16) (17) (18) (19) (20) (21) (Reply) (Go Down)
Re: Can Somebody Please Teach Me Pidgin? by AmerOmoge(f): 3:10pm On May 27, 2007 |
i try, |
Re: Can Somebody Please Teach Me Pidgin? by 9ja4eva: 4:23am On May 28, 2007 |
Yu dey try oh |
Re: Can Somebody Please Teach Me Pidgin? by mishoo(m): 8:02am On May 28, 2007 |
My people, i dey hail oooo!! Na who dey for this house I don land gidigba !! |
Re: Can Somebody Please Teach Me Pidgin? by AmerOmoge(f): 3:04pm On May 28, 2007 |
mishoo what are you screaming about oh!!!! |
Re: Can Somebody Please Teach Me Pidgin? by AmerOmoge(f): 3:21pm On May 28, 2007 |
if u don land in lagos where u dey before? part of teachin me pidgin is you have to translate it too oh!!! i still be vexed about the jelly jelly ting o! bicos i no sabi wetin that is!!! |
Re: Can Somebody Please Teach Me Pidgin? by DisGuy: 12:12am On May 29, 2007 |
make he dey scope u, u too dey jelly jelly. You wan pai !! i think he meant you are too soft not assertive, something like dat according to his words: dont make him decieve you or dont buy his crap |
Re: Can Somebody Please Teach Me Pidgin? by 9ja4eva: 6:35am On May 29, 2007 |
Impressive |
Re: Can Somebody Please Teach Me Pidgin? by AmerOmoge(f): 7:42pm On May 29, 2007 |
9ja4eva: wey u dey yarning too, me or Dis guy! i like how you be like overseer, you check in say yua bit and leave!!! when you going to help me learn this thing o! |
Re: Can Somebody Please Teach Me Pidgin? by AmerOmoge(f): 7:53pm On May 29, 2007 |
Dis guy that helps because, I know scope can mean two things, one is longing the other is lying, but could not put it together untill i knew what jelly jelly was!!! Now it all make sense! |
Re: Can Somebody Please Teach Me Pidgin? by denex: 12:27am On May 30, 2007 |
Well, the best and easiest way to learn pidgin is to apply for a short course in the University of Benin. Believe me in 3 months, pidgin english will become your mother tongue! I actually wrote a poem in Pidgin. But I must warn you, it's racist. WHITE SKIN, BLACK MAN So I fair? Who come bad patapata? I still dey try Who come worst pass? I yellow naim make me fair My brother different so therefore E bad Na you come good because you white Thank God I manage fair, my own don better. My sister, you no fit white sh`a try fair If you no fit fly, shey you go still jump? Take wig make you wear,see cream sef make you rub No be God? Black na disease wey get drugs. Thank you Oyibo, you too try for us If no be you, we still for dey mad Thank you say this blackness go soon stop Thank you O, this madness go soon cure. But no mind me O, I jus wan ask No jus mind me at all, but why you dey tan? If black so bad, why you like am. E wan come be say na you sef dey mad. Sorry O, but E dey somehow You no like black but you wan black Na white better pass, you born half caste Which kain palaver come be all that? Oyibo sir, abeg I know understand. "Master" please help me explain Jesus, God, Angel: all na white. This your "wayo" sef, na today? Everything wey black jus bad Black magic, black leg, even black heart sef With your skin like overall eczema, Na you still wan dey criticize. But me I never see person wey black before Me na yellow, my wife brown, my pickin chocolate. E come be like say na ya own brain black you no see black but you think black, you imagine black. So now who come black? Your coat, your car, everything black Dye you hair black, smoke your air black, wear dark shade make you dey see black. So bros, tell me who come bad. You wan' come brainwash your slave: "Black is beautiful"; "black n proud" you forget say black na state of mind. You don already black finish You jus dey shame to talk am But as you dey resist na ya sef you dey punish. You wan black, you dey try, so claim am with pride. "Crazeman wey 'gree don already cure. So go ask John Hawkins, ask Lord Lugard. Who come kill my papa, who thief my land? Black Man! NEX. |
Re: Can Somebody Please Teach Me Pidgin? by ghettochyk(f): 2:38am On May 30, 2007 |
bravo!!! bravo!!! dat was great Denex!!!! |
Re: Can Somebody Please Teach Me Pidgin? by DisGuy: 12:59am On May 31, 2007 |
you reall try oga denex, ifo won hear as you dey read am i go gbadun the thing well well you try man guy |
Re: Can Somebody Please Teach Me Pidgin? by worldman(m): 12:15pm On Jun 01, 2007 |
i fit teach u pidgin because me i born grow up with pidgin if u go fit pay me go teach u infact which part of the world u dey 4 me i dey wait for u if u ready tell me i go teach u |
Re: Can Somebody Please Teach Me Pidgin? by AmerOmoge(f): 8:20pm On Jun 01, 2007 |
worldman: i dey here!!! |
Re: Can Somebody Please Teach Me Pidgin? by Nobody: 1:20am On Jun 06, 2007 |
DisGuy ur runs tight i dey tell u. Aboy focus ur hustle. ur erema suppose arrange ur asiv go obodo oyingbo so u go teach and gi'am belle. sho get? meanwhile Port Harcourt pidgin different slightly from LA pidgin but Waffe' naim correct pass abi? |
Re: Can Somebody Please Teach Me Pidgin? by 9ja4eva: 3:41am On Jun 06, 2007 |
Kai una dey deal with pidgin ere oh Make una well done oh |
Re: Can Somebody Please Teach Me Pidgin? by Nobody: 11:13pm On Jun 23, 2007 |
AmerOmoge: whats happening to thread? where's AmerOmoge? |
Re: Can Somebody Please Teach Me Pidgin? by DisGuy: 11:22pm On Jun 23, 2007 |
ziddy: i dont gi'am belly sharp sharp, who no like visa dis strike dey fire my head o abi no bi so |
Re: Can Somebody Please Teach Me Pidgin? by ikamefa(f): 11:25pm On Jun 23, 2007 |
chai! na where i been dey since? wey i no see this thread? 18 pages long and counting? wey the pikin wey wan learn pidgin? |
Re: Can Somebody Please Teach Me Pidgin? by ghettochyk(f): 11:26pm On Jun 23, 2007 |
dis guy so ur still nasty. hi ika |
Re: Can Somebody Please Teach Me Pidgin? by ikamefa(f): 11:28pm On Jun 23, 2007 |
ghettochyk: haaaaaaaa @ ghetto i lay throwway salute oh! how bodi? |
Re: Can Somebody Please Teach Me Pidgin? by ghettochyk(f): 11:31pm On Jun 23, 2007 |
lol! bodi dey, i guess. |
Re: Can Somebody Please Teach Me Pidgin? by DisGuy: 11:35pm On Jun 23, 2007 |
me nasty ke? i be good boy, na condition dey make crayfish bend abi no be so? |
Re: Can Somebody Please Teach Me Pidgin? by ghettochyk(f): 11:51pm On Jun 23, 2007 |
lol!! if you say so. |
Re: Can Somebody Please Teach Me Pidgin? by denex: 1:12am On Jun 24, 2007 |
@ghettochyk & Dis guy thanks for hailing my poetry. That is the result of schooling in Benin. Dem reverse my natural-born phon to conc pidgin. |
Re: Can Somebody Please Teach Me Pidgin? by moondust(m): 4:21pm On Jun 27, 2007 |
anything wey u wan learn, first talk am for oyinbo so that I go interprete |
Re: Can Somebody Please Teach Me Pidgin? by 9ja4eva: 1:58am On Jul 01, 2007 |
Wetin dey boom for hia |
Re: Can Somebody Please Teach Me Pidgin? by AmerOmoge(f): 7:29am On Jul 02, 2007 |
I dey here oh!!! |
Re: Can Somebody Please Teach Me Pidgin? by Nobody: 12:05am On Jul 03, 2007 |
thought all these people had scared you off the forum with their talk of nigerian 419. nice pic you got there on your profile. you're one hell of a foxy akata akata=fox (yoruba language). no pun intended here babe! |
Re: Can Somebody Please Teach Me Pidgin? by DisGuy: 12:10am On Jul 03, 2007 |
you mean she be foxy fox? |
Re: Can Somebody Please Teach Me Pidgin? by 9ja4eva: 2:57am On Jul 03, 2007 |
@Amer You be 9jerian? |
Re: Can Somebody Please Teach Me Pidgin? by AmerOmoge(f): 7:38am On Jul 03, 2007 |
@ziddy Fear no catch me o I dey break from forum bicos I comot America for a conference. I'll be back in England next week. Thank you again for the compliment 9ja4eva: Only at heart , I am Black (African-American), born and raised in the States. |
(1) (2) (3) ... (15) (16) (17) (18) (19) (20) (21) (Reply)
Sultan of Sokoto: North Is The Worst Place To Live, Bandits Operate Freely / Origin Of The Name Yoruba / Where Yoruba And Igbo Peoples Meet - Ugbodu, Delta State.
(Go Up)
Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10) Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 25 |