Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,160,450 members, 7,843,381 topics. Date: Wednesday, 29 May 2024 at 12:59 AM

Ajepako Girls Na Dem Dey Form Pass - Romance - Nairaland

Nairaland Forum / Nairaland / General / Romance / Ajepako Girls Na Dem Dey Form Pass (2095 Views)

"Butty"babes Voice Are Alws Tiny But "Ajepako"babes Voice Are Alws Thick. WHY? / Most Girls Na Cheaters / Quickest Way To Know An Ajepako Naija Babe (2) (3) (4)

(1) (Reply) (Go Down)

Ajepako Girls Na Dem Dey Form Pass by Nobody: 6:27pm On Sep 11, 2011
omo the thing don pass me o! grin
imagine say babe wey no get level(ajepako) na im sabi form pass.i remember back in my skul days in lagos ajepako girls dem really dey boku but then na dem dey form pass and act as if dem no get sh1t for yansh.i remember one babe then wey i carry go amala joint an dis babe sef get big tribal marks for face but come see as she dey form."no darling i dont take all these dirty stuff u know".she come say then i come reply,"but baby these are real african dishes and as a real african lady u should be used to such",then the babe come reply,"darlin if u dont take me to mr biggs or chicken republic then nothing for u o!".i just shake my head and call am yeye ajepako girl for my mind.i remember dis calabar chick name Ekaete Iniobong wey i take go mister biggs after she refuse to go mama put with me.after she don demolish five plates of fried rice,two thick lap of chicken,six huge cups of ice cream and a bottle of small stout she come hug me and say,"oh baby thanks you for gaving me the rices and its chickens".chie! i come wonder,not only is dis babe a proper ajepako she also dey murder d english language die grin.even den there was this fine very light skinned igbo babe wey i be come dey trip for and as a proper guy man i come track am reach her school for east and there i come lost her hostel address so na im i come ask one babe with K-leg wearing undersized manchester united jersey and tight jeans the address of the hostel wey i dey look for.come see as d babe with duckeyes come dey halla,"shuo!! u no go leave me alone!! u no know say i dey late for crass!(class).wetin dey do this babe i just come dey wonder.fine u no fine i dey ask u for directions and u dey accuse me of toasting u haba!.anyway sha i be come manage get the direction to the hostel and the babe wey give me d right direction be dey a bit ok only say her collarbones be dey show and she come even wear t-shirt we emphasize her bony shoulders.i come reach d babe hostel and u can imagine my surprise wen i come jam dis igbo chick and her friends dey demolish a huge bowl of akpu and egusi soup and dis one na d same babe wey say im no fit eat heavy food grin grin grin.ajepako naija girls una own don too much sef grin grin
Re: Ajepako Girls Na Dem Dey Form Pass by Nobody: 6:38pm On Sep 11, 2011
Yeah! And na Ajepako guys they fall for their formings pass! undecided
Re: Ajepako Girls Na Dem Dey Form Pass by skypon2002(m): 6:39pm On Sep 11, 2011
lefulefu:

omo the thing don pass me o! grin
imagine say babe wey no get level(ajepako) na im sabi form pass.i remember back in my skul days in lagos ajepako girls dem really dey boku but then na dem dey form pass and act as if dem no get sh1t for yansh.i remember one babe then wey i carry go amala joint an dis babe sef get big tribal marks for face but come see as she dey form."no darling i dont take all these dirty stuff u know".she come say then i come reply,"but baby these are real african dishes and as a real african lady u should be used to such",then the babe come reply,"darlin if u dont take me to mr biggs or chicken republic then nothing for u o!".i just shake my head and call am yeye ajepako girl for my mind.i remember dis calabar chick name Ekaete Iniobong wey i take go mister biggs after she refuse to go mama put with me.after she don demolish five plates of fried rice,two thick lap of chicken,six huge cups of ice cream and a bottle of small stout she come hug me and say,"oh baby thanks you for gaving me the rices and its chickens".chie! i come wonder,not only is dis babe a proper ajepako she also dey murder d english language die grin.even den there was this fine very light skinned igbo babe wey i be come dey trip for and as a proper guy man i come track am reach her school for east and there i come lost her hostel address so na im i come ask one babe with K-leg wearing undersized manchester united jersey and tight jeans the address of the hostel wey i dey look for.come see as d babe with duckeyes come dey halla,"shuo!! u no go leave me alone!! u no know say[b] i dey late for crass!(class).[/b]wetin dey do this babe i just come dey wonder.fine u no fine i dey ask u for directions and u dey accuse me of toasting u haba!.anyway sha i be come manage get the direction to the hostel and the babe wey give me d right direction be dey a bit ok only say her collarbones be dey show and she come even wear t-shirt we emphasize her bony shoulders.i come reach d babe hostel and u can imagine my surprise wen i come jam dis igbo chick and her friends dey demolish a huge bowl of akpu and egusi soup and dis one na d same babe wey say im no fit eat heavy food grin grin grin.ajepako naija girls una own don too much sef grin grin

Rotflmfao  grin grin grin
no kill me with laff ooo
Re: Ajepako Girls Na Dem Dey Form Pass by Nobody: 6:41pm On Sep 11, 2011
cheesy cheesy guy why na so so ajekpako girls wey you dey follow?
Re: Ajepako Girls Na Dem Dey Form Pass by Nobody: 6:45pm On Sep 11, 2011
pDude:

cheesy cheesy guy why na so so ajekpako girls wey you dey follow?
guy i just dey give my experience wit ajepako babes.i be all rounder sort of guy(i date both ajebutters and d ajepakos as well)
Re: Ajepako Girls Na Dem Dey Form Pass by Nobody: 6:49pm On Sep 11, 2011
skypon2002:

Rotflmfao  grin grin grin
no kill me with laff ooo
my brothe u never hear half of the tory and laugh wan kill u?
chei how i wish say space dey this thread i for tell u the genesis and the revelation of ajepako naija girls both in naija and the uk but den i know say many of the babes here go vex if i start to dey open their yansh grin grin grin grin
Re: Ajepako Girls Na Dem Dey Form Pass by toyemz(f): 9:47pm On Sep 11, 2011
@poster
you no say this na kiss and tell you dey do oh?
just thot i should let you know
Re: Ajepako Girls Na Dem Dey Form Pass by Nobody: 11:56am On Sep 12, 2011
toyemz:

@poster
you no say this na kiss and tell you dey do oh?
just thot i should let you know
kiss and tell ko? grin grin
kiss and tell ni? grin grin grin
as long as d babe no dey around dey hear wetin i dey talk i get da freedom to yarn my runs with da guys in da house grin grin grin
Re: Ajepako Girls Na Dem Dey Form Pass by Nobody: 12:00pm On Sep 12, 2011
sexkillz:

Yeah! And na Ajepako guys they fall for their formings pass! undecided
ur own condition pass ajepako one sef grin grin grin
i don already diagnose ur case na chronic congitolata na im dey worry u grin grin
Re: Ajepako Girls Na Dem Dey Form Pass by Goldieluks: 12:03pm On Sep 12, 2011
lefulefu Rephrase your topic please. undecided
Re: Ajepako Girls Na Dem Dey Form Pass by Nobody: 12:16pm On Sep 12, 2011
Goldieluks:

lefulefu Rephrase your topic please. undecided
u don come wit ur wahala again grin grin
Re: Ajepako Girls Na Dem Dey Form Pass by Goldieluks: 12:23pm On Sep 12, 2011
lefulefu:

u don come wit your wahala again grin grin

Person no fit ask simple question/request again? angry undecided
Re: Ajepako Girls Na Dem Dey Form Pass by Nobody: 12:49pm On Sep 12, 2011
Goldieluks:

Person no fit ask simple question/request again? angry undecided

your case different because u too dey ask for more angry angry
abi u be Oliver Twist? shocked shocked
Re: Ajepako Girls Na Dem Dey Form Pass by Goldieluks: 2:06pm On Sep 12, 2011
Lmao^^ grin
Re: Ajepako Girls Na Dem Dey Form Pass by tellwisdom: 3:51pm On Sep 12, 2011
your own condition pass ajepako one sef grin grin grin
i don already diagnose your case na chronic congitolata na im dey worry u grin grin

grin grin, The guy don suffer o, im sure, na milk he go dey piss comot instead of urine grin grin
Re: Ajepako Girls Na Dem Dey Form Pass by Nobody: 2:51am On Sep 14, 2011
tellwisdom:

grin grin, The guy don suffer o, im sure, na milk he go dey piss comot instead of urine grin grin
lmbao!! grin grin grin grin
Re: Ajepako Girls Na Dem Dey Form Pass by itiswell1(m): 7:44am On Sep 14, 2011
pDude:

cheesy cheesy guy why na so so ajekpako girls wey you dey follow?

Birds of same feather
Re: Ajepako Girls Na Dem Dey Form Pass by mikkymoi(m): 10:33am On Sep 14, 2011
@post, you're comfirm Ajepako dats yyy u akwaz meet Ajepako
Re: Ajepako Girls Na Dem Dey Form Pass by bis012001: 3:54pm On Sep 14, 2011
@lefulefu them no day sell small stout for mr biggs
Re: Ajepako Girls Na Dem Dey Form Pass by MMM2(m): 4:00pm On Sep 14, 2011
am come home embarassedembarassed
Re: Ajepako Girls Na Dem Dey Form Pass by Ranoscky(m): 4:07pm On Sep 14, 2011
^^ Which language be that?
Re: Ajepako Girls Na Dem Dey Form Pass by jamace(m): 5:00pm On Sep 14, 2011
grin grin grin

(1) (Reply)

Ladies Can U Marry A Man That Eats Once A Day? / She Said Am Domineering And I Think She Is Too Cold. Please Help Marriage Issue! / Advice, My Girl Friend Of 3yrs Is Leaving Me.

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 33
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.