Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,152,770 members, 7,817,127 topics. Date: Saturday, 04 May 2024 at 06:40 AM

Warri Parables: Words Of Our Popsi's - Culture - Nairaland

Nairaland Forum / Nairaland / General / Culture / Warri Parables: Words Of Our Popsi's (42666 Views)

Some Funny Warri Parables - By Rapmoney / Words Of Tribal Origin Used As General Slangs & Their Meanings / Warri Parables (2) (3) (4)

(1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10) ... (11) (Reply) (Go Down)

Warri Parables: Words Of Our Popsi's by Chrisbenogor(m): 10:16pm On Oct 15, 2008
This na strictly unto waffi parade, all the things wey we dey yarn steady for Warri, just one liners.  grin grin
Re: Warri Parables: Words Of Our Popsi's by Chrisbenogor(m): 10:22pm On Oct 15, 2008
OK make I throway for una

Before you marry woman make u look e mama well because mango nor dey fall far from tree.

Escort me, Escort me, naim slave trade take start.

Na where tree near tree naim monkey dey smart, grin

1 Like

Re: Warri Parables: Words Of Our Popsi's by Okijajuju1(m): 10:36pm On Oct 15, 2008
I no be waff but P-town no day carry last.

Anyhow sha, dis na my own;

When Pikin don dey crase, ehn mama go say na rascal.
Re: Warri Parables: Words Of Our Popsi's by Chrisbenogor(m): 10:41pm On Oct 15, 2008
@Okija
Nothing Do you we all na Niger Delta you know say

Them dey pursue fine animal enter bush, Pig say na because him dodge, naim make them no catch am! grin

1 Like

Re: Warri Parables: Words Of Our Popsi's by Okijajuju1(m): 10:49pm On Oct 15, 2008
Guy! Carry go!!


No matter How elepahant strong reach, E no fit fight earthquake.
Re: Warri Parables: Words Of Our Popsi's by Chrisbenogor(m): 10:54pm On Oct 15, 2008
LMAO
Make we no forget the al timers oh
One good turn……… na power steering be that.
A bird in hand……, na christmas chicken food be that.
He who laughs last……, na mumu. Na now he know wetin dey happen?
The patient dog……, Na hunger go kill am,
Re: Warri Parables: Words Of Our Popsi's by Nobody: 11:01pm On Oct 15, 2008
Chrisbenogor:

LMAO
Make we no forget the al timers oh
One good turn……… na power steering be that.
A bird in hand……, na christmas chicken food be that.
He who laughs last……, na mumu. Na now he know wetin dey happen?
The patient dog……, Na hunger go kill am,


Lmao grin grin grin Omg
Re: Warri Parables: Words Of Our Popsi's by Okijajuju1(m): 11:03pm On Oct 15, 2008
Chrisbenogor:

LMAO
Make we no forget the al timers oh
One good turn……… na power steering be that.
A bird in hand……, na christmas chicken food be that.
He who laughs last……, na mumu. Na now he know wetin dey happen?
The patient dog……, Na hunger go kill am,



No be lie, over talent wan kill you.
Re: Warri Parables: Words Of Our Popsi's by Chrisbenogor(m): 11:12pm On Oct 15, 2008
Bros no blame me grin after some bottles of beer and gist with my old buddies wetin man go do, plus no early work tomorrow I say make I salute the other brothers out here oh, because

A stitch in time, …, dey prevent further tear tear.
A rolling stone ……… na person push am
Birds of the same feather……… na the same mama born dem
Re: Warri Parables: Words Of Our Popsi's by Okijajuju1(m): 11:20pm On Oct 15, 2008
Na our people talk am say

He who lives to fight today, No get power.

I no fit shout. I see say na area dem breed you.
Re: Warri Parables: Words Of Our Popsi's by Chrisbenogor(m): 11:28pm On Oct 15, 2008
O boy no be small thing oh, no be we dey even represent that time abi you no know say

e get where bros go get bald head reach dem go call am papa?

Mosquito wey dey brocos na small small them dey take kill am oh

2 Likes

Re: Warri Parables: Words Of Our Popsi's by Okijajuju1(m): 11:54pm On Oct 15, 2008
Free that yarns, from the way wey you just dey quote E show say you na for area you grow


Pikin wey say ehn mama no go rest, That pikin qua no go rest.
Person wey no go river no dey die water.
Re: Warri Parables: Words Of Our Popsi's by Chrisbenogor(m): 6:59am On Oct 16, 2008
Area! Area!! Area!!!
Even if fowl swallow stone na water e go shit

1 Like

Re: Warri Parables: Words Of Our Popsi's by Seun(m): 10:01am On Oct 16, 2008
Nice thread. Moved to Culture subsection.
Re: Warri Parables: Words Of Our Popsi's by Raimond(m): 10:24am On Oct 16, 2008
I`m feeling this thread,more please!!!!
Re: Warri Parables: Words Of Our Popsi's by laceybric(f): 10:48am On Oct 16, 2008
Chrisbenogor:

LMAO
Make we no forget the al timers oh
One good turn……… na power steering be that.
A bird in hand……, na christmas chicken food be that.
He who laughs last……, na mumu. Na now he know wetin dey happen?
The patient dog……, Na hunger go kill am,



Ma guy, u too mush ooo!!!! grin grin

If you c mammywater,neva you runaway oo!!!(4rm victor uwaifo)
Re: Warri Parables: Words Of Our Popsi's by Fancier(f): 10:54am On Oct 16, 2008
mennnnnnnnnn!!! i no fit laugh ooooooooooooo cheesy cheesy cheesy grin grin grin grin

This is a very funny thread infact Poster you re great

Abeg make all the Areas on nairaland come show their Logo now like the poster
Re: Warri Parables: Words Of Our Popsi's by littlecaf(m): 10:57am On Oct 16, 2008
area! area!! area!!!
na original waffi eh na dorn land here so, any how way e wan be eh make he be i dorn talk  i dorn talk   see you next toime on this same N.I.A.R.A LAND, EHEN MY NAME obakpororonaroro oghene roro otioeh (A.K.A )CLEVER BAD MOUTH  if you go warri as of me fendral na i abi okumagba layout infact every were
Re: Warri Parables: Words Of Our Popsi's by skfa1: 11:00am On Oct 16, 2008
I can't shout laugh hehehehe funny thread  grin

@ Chrisbenogor

Is that you or me ?  grin
Re: Warri Parables: Words Of Our Popsi's by SeXYhOTmOM(f): 11:09am On Oct 16, 2008
christo

i dey hail u o!!
i no fit shout
abeg no stop here o!!!

dem say dog wey won los
e no dey hear im master whistle
Re: Warri Parables: Words Of Our Popsi's by littlecaf(m): 11:14am On Oct 16, 2008
i dor come back again dem say waffi no dey carry last na true say since them born me i no fit carry last
Re: Warri Parables: Words Of Our Popsi's by skfa1: 11:16am On Oct 16, 2008
littlecaf:

i dor come back again them say waffi no dey carry last na true since them born me na so so last i dey carry

No tell me say you mean am
Re: Warri Parables: Words Of Our Popsi's by chickslord: 11:18am On Oct 16, 2008
if i hear am . . . . . .
pikin when no know him mama boyfriend na him dey call am uncle.
na strong thing when plantain c na im make dem call am boli.
hole am hole am na im butterfly take dey enter bush.
na tey e go tey stammerer go call him mama name.
na dere u go fear grove inside gbedu.
even jaguda get oga!
na so we go dey?
Re: Warri Parables: Words Of Our Popsi's by skfa1: 11:19am On Oct 16, 2008
SeXYhOTmOM:

christo

i dey hail u o!!
i no fit shout
abeg no stop here o!!!

them say dog wey won los
e no dey hear I'm master whistle

E be like say you no know dogs of this days, even if im master whistle im no go answer, na so im go los.
Re: Warri Parables: Words Of Our Popsi's by skfa1: 11:21am On Oct 16, 2008
chickslord:

if i hear am . . . . . .
pikin when no know him mama boyfriend na him dey call am uncle.
na strong thing when plantain c na I'm make them call am boli.
hole am hole am na I'm butterfly take dey enter bush.
na tey e go tey stammerer go call him mama name.
na dere u go fear grove inside gbedu.
even jaguda get oga!
na so we go dey?

Also pikin wey no know him papa na him go dey call him mama boy friend dady.
Re: Warri Parables: Words Of Our Popsi's by AKO1(m): 11:32am On Oct 16, 2008
He who lives in a glass house. . . . na him pepe rest wink
Re: Warri Parables: Words Of Our Popsi's by Exstar(f): 11:34am On Oct 16, 2008
@ post,
I dey ''Dugwe'' for you, you too much, i jos dey feel you left, right and center! kiss
Re: Warri Parables: Words Of Our Popsi's by skfa1: 11:37am On Oct 16, 2008
A_K_O:

He who lives in a glass house. . . . na him pepe rest wink


hehehe u crack me up big time grin . Na him pepe rest o my bro.
Re: Warri Parables: Words Of Our Popsi's by smile4kenn(m): 11:41am On Oct 16, 2008
A_K_O:

He who lives in a glass house. . . . na him pepe rest wink

na true u talk, how rich man wan throw stones.


plz more
Re: Warri Parables: Words Of Our Popsi's by SeXYhOTmOM(f): 11:43am On Oct 16, 2008
A_K_O:

He who lives in a glass house. . . . na him pepe rest wink


bros i say mingwo to u

dey say no be crime 4 pickin 2 get big teeth
d tin be say make e get big lip 2 take cover am grin
Re: Warri Parables: Words Of Our Popsi's by ThisDumebi: 11:46am On Oct 16, 2008
hey hey!! All of una try at allll. Na for dis Naraland wey we dey so na im dis dey shele?

If dem giv una chance eh, u na go push trailer start o!

If dem giv una chance eh, u na go put weave-on for armpit o! grin grin

1 Like

Re: Warri Parables: Words Of Our Popsi's by Chrisbenogor(m): 11:51am On Oct 16, 2008
Area! Area!! Area!!!
Who be dat my guy wey stay okumagba, I throway three and half Awilo Gunshot for you!
Na me be oderoghenemukokworakpona obunor the original. Na we colonise Emebiren with poloko. Our headquaters that year na for Olodi primary school.
Una too much abeg how warri wan take carry last.

(1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10) ... (11) (Reply)

Meet Wodaabe Men, A Fulani Ethnic Group Who Make-up For Easy Marriage, / Naomi Oluwaseyi Stuns In New Photo / Photos: Nigerian Woman Spotted Eating Amala On A Train In The UK

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 26
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.